US rapper Meek Mill Music video Shoot for Jubilee House Vex Ghanaians

By

Some Ghanians dey para well well as ‘celebrated’ American rapper, Meek Mill shoot some part of im music video for Jubilee House, wey be di Presidential Palace for di kontri.

Di video show as Meek Mill dey for different places for di Presidency, from di frontage to di main corridors, and inside di main conference hall as im dey rap.

Meek Mill bin visit di West African kontri and some of di major highlights of im time for Ghana include meeting wit Ghana President Nana Akufo Addo for Jubilee House.

Oda tins Meek Mill do for Ghana na one rough ride session of power bike.

Im bin also claim say dem tiff im phone from one event, im also fight some Jaguda pipo before im climb stage to perform.